Stakeholders Begin Negotiation Afta Industrial Action Paralyse Flight … – NNN NEWS NIGERIA

Published
on
By
Passengers hook on Monday for Lagos and Abuja airport for Nigeria.
Dem hook sake of strike action by staff of di Nigeria Aviation handling company.
Reports say NAHCO staff strike sake of poor pay and bad welfare from dia management.
Dia strike affect flight for Murtala Muhammed International Airport and Nnamdi Azikiwe international according to wetin BBC Pidgin find out.
Fotos show show how pipo full di airport check-in counter area wit luggage everywia.
Murtala Muhammed International airport na one of di busiest airports for di kontri sake of di number of flights wey dey take off and land dia and di number of passengers wey dey pass through di airport on daily basis.
DI staff dey demand for increased salary and better working condition from NAHCO management.
One staff of NAHCO wey tok to BBC Pidgin anonymously say dem don dey battle wit poor working condition for a long time now.
Dem no even allow flights to land. Di strike start 3:00am today.
“Passengers cannot travel, dem dey stuck for di airport, infact di one wey come from Qatar don go back. Nobody dey handle anytin dem no gree.” She tok.
Di NAHCO staff tok say di mata don dey on for a while but di authorities no gree negotiate wit dem.
“Especially di boys for di ramp, dia salaries dey notin to write home about. Men, family men dey dia, dem get fees to pay, house rent and yet some of dem dia salary no rach 100k.
Di guys na di ones wey dey load di bags for di aircraft, NAHCO own dey dia plus di difficulty of di international airport, di baggage services for international airport dey in a mess, di boys over dia, wen dem leave dat side to come up dem go get body odour like say dem enta inside mud.
Most of di time di carousel for di airport no dey work, di boys go come dey push di bags manually to load am inside di aircraft and yet you no wan make dis boys smile?” She tok.
She also tok say dem bin don dey negotiate wit management but e no get head hence di strike.
Dem don dey do dis toks back and forth, instead of NAHCO management to appease us dem come go court to get injunction say make we no go on strike, na wetin make di boys vex. ” She tok.
Inside one notice of strike wey di National Union of Air Transport Employees , NUATE issue NAHCO staff wey dey dated 16, January, 2023, di union say although dem don dey negotiations wit di management of NAHCO, e never get head.
“As dem no gree reason all ultimatum issued by our unions and di management continue to play on our intelligence through scheduling purposeless meetings, we don come to di conclusion say dem don decide say dem no go listen to our cries for fairness and equity, despite overwhelming evidence in support of demand.
In di above regard, all staff of NAHCO dey hereby directed to withdraw all service with efect from Monday, 23, 2023.” Di statement tok.
As di strike dey happun, NAHCO staff wey dey represented by di unions, NUATE, do meeting wit di airport authorities on Monday ontop di mata.
One staff of NAHCO tell BBC Pidgin say dem don call dem to go back to work for now.
Inside one internal memo wey BBC Pidgin take eye see wey dey addressed to NAHCO staff, management say afta dia meeting wit regulatory agencies and NUATE and di Air Transport Senior Staff Association of Nigeria (ATSSAN), , dem don withdraw di suit against dem for court and resume negotiation.
Some of di resolutions dem meet for di meeting on Monday as a result of di strike wey paralyse activities for di airport include say a counter offer to di union demands go dey issued by management before close of business on Monday 23, January 2023.
“We dey confident say we go dey able to arrive at an agreement wey go provide competitive wage and benefit package for you all.” Di statement read in part.
Na NAHCO dey handle check-in, boarding and ramp services for many international airlines.
Di airlines dem dey work for na Qatar Airways, Ethiopian Airlines, Air France/KLM, Delta Airlines, Virgin Atlantic, Turkish Air as well as several Nigerian airlines including Air Peace.
Dis dia strike action dey come as President Muhammadu dey visit Nigeria commercial.
Credit: https://www.bbc.com/pidgin/articles/c72rg76e8ejo
https://nnn.ng/naira-black-market-exchange-rate-today/

Everton sack Frank Lampard
Chelsea plan renewed push to sign Enzo Fernández from Benfica
NNN is an online news portal that publishes breaking news in around the world. Contact: editor @ nnn.ng. Disclaimer.
Barcelona beats 10-man Sociedad 1-0 to reach Copa semifinals
CBN insists on Jan 31 deadline, shuns calls for extension
The aftermath of Bayern Munich vs. FC Köln; Liverpool whiffs on Bayern player; Lionel Messi still working out deal with PSG; Gareth Bale is living his dream; An update on Harry Kane; & MORE!
Senate suspends plenary till Feb. 28
Tottenham sign Nigeria-born Danjuma on loan from Villarreal
Marketers in Sokoto choose e-Naira transactions
Adult Swim cuts ties with ‘Rick and Morty’ co-creator Justin Roiland following domestic abuse charges
Mikaela Shiffrin wins again, two away from Ingemar Stenmark’s record
NASS asks CBN to extend the deadline on old naira notes by six months
Deadline remains Jan 31 for old naira notes
‘Arsenal move is the pinnacle of my career’
Lethal Olmo sees Leipzig go second with win at Schalke
Classified documents found at former vice-president’s home
Arsenal signing went from eating doughnuts for lunch to marking Messi in Qatar
Why Carabao Cup glory would mean so much to Toon Army
Lionel Messi Will Not Feature When Paris Saint-Germain (PSG) Take On Pays De Cassel In The Coupe De France On Monday (January 23). The Argentine Forward Has Not Been Included In The Squad For Their Away Game In The French Cup.
Kylian Mbappe scores PSG-record five goals in French Cup shutout
How Bell’s Palsy diagnosis stalled my career for years
FCTA Takes Pre-Emptive Measures Against Diphtheria Disease
Aero Threatens Legal Action Over Loss Of Revenue From NAHCO Strike
Buhari commissions Lekki Deep Sea Port
Lekki Deep Seaport Targets $361bn Revenues, 200,000 Jobs  
Live stream, TV channel, kick-off time & where to watch
Kwara SWAN elects new officers

Contact: editor @ nnn.ng

source

Leave a Comment